The New KOGI
KOGI STATE ISSUES
KOGI ELECTION TRIBUNAL UPDATE
Today 2/4/2024 Kogi Election Tribunal come sit as dem dey normally do.
Barr. Akubo SAN and other lawyers dey present, na so Barr. Akubo come still bring up the matter say dem dey attack house of Ebira people wey dey come court come witness and Judge sef come vex this time around even INEC lawyer wey be Barr. Agabi come talk say election for Nigeria and Kogi don turn another thing.
So even as dem dey attack people wey dey do witness dem come still show for court come talk very well how mago mago full the election for Kogi Central wey dem vote infact one Aziz from Okehi finish work for there today.
INEC lawyer ask am: You come complain because you be SDP member abi?
Aziz: I no be any party member I be voter and I get right to complain if dem no do well for me i vote.
NIEC lawyer: you protest for there say the election no good?
Aziz: Yes
INEC lawyer: Presiding officer no do correct thing for there?
Aziz: na the Presiding officer even do ojoro pass for there
INEC lawyer: which party come benefit for the overvoting?
Aziz: I no sabi that one oh!
INEC lawyer come tire for here say e wan rest small before e come continue...
INEC lawyer: which party you come vote for that day?
Aziz: that one na my business no be your business
INEC lawyer: who come write this petition for you?
Aziz: na me and my lawyer write am
INEC lawyer: you say U no belong to any party how come you come put Muri and SDP for your petition?
Aziz: because I no see any party wey go court na only dem
INEC lawyer: you fit remember how many people register for your polling unit?
Aziz: No
INEC lawyer: Accreditation nko you fit remember?
Aziz: yes na 299
INEC lawyer: how many votes dem come announce las las?
Aziz: na 595 dem come announce
INEC lawyer: you get copy for the result?
Aziz: No
INEC lawyer: you get voters register?
Aziz: No
INEC lawyer: you get PVC to show say you be voter that place?
Aziz: yes (e come present am)
Na so dem continue with other people wey come dey witness today but Aziz own sweet me because even INEC lawyer come tire for the way e dey answer sef because that e talk come make some Ebira thugs like Abdul Dollar for there come dey vex but nothing dem fit do.
Court come adjourn the matter to tomorrow 3rd April 2024.
Omera Ugbede Opaluwa (Facebook)
01/04/2024
Get this today to boost your business, palmpay POS terminal is the fastest network in Nigeria and has the lowest charges rate,call me on this to get urs 08163856977, you can also chat me on this same number, delivery all over Nigeria
KOGI ELECTION TRIBUNAL UPDATE TODAY 1/4/2024
Court come resume early, na so witnesses from Kogi Central come out again come give out evidence say the election na mago mago for their side that day.
INEC lawyer and APC lawyers question dem well well and dem get mind answer well.
Some Ebira APC people come dey vex small but dem no fit talk or do anything as security ready for dem.
All the witnesses wey SDP bring come today talk dem come adjourn case go tomorrow 2nd April 2024 for more.
The case is favoring us, Kogi should celebrate.
Ganaja road is 80% done Ododo is working
How do you see Ododo step so far?
24/02/2024
Shout out to my newest followers! Excited to have you onboard! Feyisetan Adeyemi, Samuel Omaókuñ, Joshua Aina, Alemeru Moronike Victoria, Monday Baki
What can you say about Kogi State today?
That's the movement Kogi Kimurida 11/11/23
Click here to claim your Sponsored Listing.
Location
Contact the business
Telephone
Address
Abuja
900266
